Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Dem dey plan to relocate Suleja Correctional Facility afta di jailbreak

April 26, 2024

The Federal Government don talk say dem dey consider relocation of di Medium Security Custodial Centre for Suleja, Niger State, afta di jailbreak wey see 119 inmates escape.

During one visit to di centre yesterday, di Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, reveal say di facility dey house 499 inmates instead of di 250 wey e bin suppose dey built for.

Im also confirm say 119 inmates don escape, but dem don re-arrest 13 of dem, while di facility management go publish di names and pictures of di escaped inmates from di centre.

Heavy rainfall bin spoil plenty things for di Custodial Centre, including di perimeter fence wey e breach, wey make some of di inmates fit escape.

More Posts