Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Dapo Abiodun don appoint Tunde Onakoya as Sports Ambassador

April 26, 2024

Ogun State Governor, Prince Dapo Abiodun, don appoint National Chess Master, Tunde Onakoya, as di Sports Ambassador of di State afta im break world record for chess marathon for Times Square, New York.

Governor Abiodun disclose dis one yesterday wen im receive Onakoya for im office for Oke-Mosan, Abeokuta. Im also announce di start of di state chess competition wey go happun for different parts of di state to honour Onakoya.

Di governor, wey impressed with di achievement of di National Chess Master for di global stage, hail am for im determination to succeed without any form of shady dealings. Im tok say wit dis feat, Onakoya don join di league of distinguished sons and daughters wey don bring honour to Ogun State for dia various fields of endeavour.

More Posts