Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Veteran Nollywood actor, Zulu Adigwe don kpai

April 24, 2024

Zulu Adigwe, one veteran Nollywood actor, don kpai. Di actor kpai on Tuesday, April 23, 2024. E gain fame for im role as Mr. B for Ken Saro-Wiwa’s soap opera Basi and Company (1987).

Di tori don confam by di movie producer Stanley Nwoko for Instagram.

“I regret to announce di passing of veteran actor, late Mr. Zulu Adigwe. Wetin cause im death never dey clear yet. Rest in peace good actor,” Nwoko tok for im post.

As we dey report dis tori, e never clear wetin cause im death.

Di latest role wey Adigwe perform na as Pascal Nworie for Ramsey Nouah’s adaptation of di beloved Living in Bondage.

More Posts