Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

UNILAG HOST PELUMI NUBI ON ARRIVAL TO NIGERIA WITH CALL ON WOMEN TO ACHIEVE GREATNESS

UNILAG host Pelumi Nubi as she return to Nigeria, with call on women to achieve greatness

April 9, 2024

Content creator Pelumi Nubi wey embark on solo road trip from London go Lagos, don land for Nigeria and dem welcome am well.

Pelumi wey spend sixty-seven days for di trip wey start on di 31st of January for London and end on di 7th of April for University of Lagos, Akoka.

As she dey talk for di reception wey University of Lagos organize for di 28-year-old Pelumi, she talk say she face some challenges for di journey, including car accident wey she get for Ivory Coast. She say di main reason for her trip na to change di story about insecurity for Africa and to encourage more Africans make dem come out from dia comfort zone and explore di continent.

Vice Chancellor of University of Lagos, Folasade Ogunsola, talk say Pelumi journey resemble di strong spirit of Nigerians, she say Pelumi journey dey inspire and e make her join di list of notable Nigerian women wey challenge di normal situation and succeed.

Chairman of Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa, call on Federal Government make dem give Pelumi national award, she say Pelumi na motivation to plenty Nigerian youths.

But she add say make dem preserve Pelumi car for historical museum.

By AYO Agbeoluwaye

More Posts