Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

UEFA go confirm 26-man squads for Euro 2024

April 24, 2024

UEFA wan confam say nations go fit get 26-man squads for di European Championship wey go happun for Germany dis summer.

Di European governing body bin get meeting for dia national competitions committee, and dem vote for di change, wey dem wan approve later dis week for di executive committee.

UEFA bin plan to go back to 23-man squads afta dem allow three-man expansion for Euro 2020 sake of di ongoing Covid-19 wahala.

Dem allow make squads expand for di 2022 World Cup wey happun for Qatar sake of say e dey happen for di middle of di domestic season.

More Posts