Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

UEFA Champions League: Bayern Beat Barcelona 3 – 0

October 27, 2022

UEFA Champions league action continue last night for the round 5 of group matches. Bayern Munich pour salt ontop Barcelon wound with 3-0 win, Liverpool also kolobi last 16 spot with 3-0 win for Ajax house. Inter Milan flog Viktoria Plzen 4-0, while Atletico Madrid kiss UEFA Champions League bye bye after dem play 2-2 draw with Bayer Leverkusen, wey don already comot since.

For other results, Tottenham settle for a 1-1 draw with Sporting Lisbon, Eintracht Frankfurt beat Olympique Marseille 2-1, Napoli use  3-0 beta pass Glasgow Rangers, and FC Porto beat Club Brugge 4-0.

Dis night, attention go shift go UEFA Europa league where PSV go host Arsenal, and Manchester United go welcome Sheriff Tiraspol

More Posts