Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Tinubu go depart Abuja today for official visit to Netherlands

April 23, 2024

President Bola Tinubu go commot Abuja today Tuesday, April 23, 2024 go Kingdom of the Netherlands for one official visit, based on di invitation wey Mark Rutte, di Prime Minister of di country send am.

Presidential spokesman, Ajuri Ngelale, for one statement wey e release yesterday, tok say as President Tinubu dey Netherlands, e go get high-level discussions with di Prime Minister, and e go also hold separate meetings with His Royal Majesty, King Willem-Alexander and Queen Maxima of di Kingdom.

Ngelale talk say di President go also attend di World Economic Forum (WEF) meeting wey dem don schedule for April 28-29 for Riyadh, Saudi Arabia, aftawards. E tok say for di meeting, President Tinubu and im people go use di opportunity wey ova 1,000 leaders from business, government, and academia go dey gather to discuss tins wey go help push forward im Renewed Hope Agenda for di country.

More Posts