Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Third Mainland Bridge Full And Proper Repair Go Start On The 1st Of November. 

October 30, 2023

Minista of Works, David Umahi, don yan say dem go start comprehensive repair of Third Mainland Bridge wey dey Lagos wey dey span 11.8 kilometers from November 1, and e go last for three months. Umahi talk dis one during hin inspection for the under deck and lagoon parts of Third Mainland Bridge and other bridges. E talk say the whole stretch of Third Mainland Bridge go undergo complete resurfacing and say dem go try make e no too disturb people wey dey use the road, as dem go do the repairs during weekends between midnight and 4.00 a.m.

Umahi still yan say e inspect the deteriorating Marina shoreline, failing parts of Five Cowries Bridge wey dey Zone Two Police Headquarters for Onikan, Ijora Bridge, and Marina Bridge for Apapa. The minister con warn say from now on, dem go dey attach a 10-year maintenance responsibility to projects for contractors to take care of repair costs if the road get wahala within that period. Any contractor wey im work fail within two years fit land for jail according to global practice to reduce bad construction work.

More Posts