Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Senate don pass N2.17 trillion 2023 supplementary budget.

November 3, 2023

Nigerian Senate don pass di N2.17 trillion 2023 Supplementary Appropriation Bill, wey Presido Bola Tinubu send recently. Dis one happun after dem agree on di report from di joint sittings of both chambers for di bill wey Senator Solomon Adeola, wey dey chair di Senate Committee on Appropriations, submit. Our reporter, Raliat Adenekan, yan say for di budget, dem allocate N210 billion for Civil Servants Salary Award, N605 billion for National Security and Defence, N300 billion for bridge maintenance, and N400 billion for cash transfer to vulnerable households, among odas.

More Posts