Naija_logo
🎧 Listen Live πŸ”΄

Live on air

El-Kanemi Warriors of Maiduguri don clinch the 2024 President Federation Cup after dem beat Abia Warriors 2-0 for the finals.

Rivers Angels and El-Kanemi Warriors don emerge champions of President Federation Cup

July 1, 2024

El-Kanemi Warriors of Maiduguri don clinch the 2024 President Federation Cup after dem beat Abia Warriors 2-0 for the finals. This na the third time wey the Maiduguri-based team don win the finals of the oldest cup competition for Nigeria, after dem win the cup for 1991 and 1992.

The Desert Warriors carry go house prize money of N50 million and dem go also compete for the CAF Confederation Cup next season.

For the women’s side, Rivers Angels emerge champions of the 2024 Nigeria President Federation Cup after dem beat Naija Ratels 1-0. This na the ninth time wey Rivers Angels don lift the President Federation Cup title.

For more news https://naija102.com/lagos/blog/

More Posts