Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Rihanna and Tems don get Oscar nomination for ‘Black Panther’

January 25, 2023

 Tems don become the first Nigerian musician wey dem go submit for Oscar award, for her role wey she chook hand inside to create Rihanna song ‘Lift Me Up’ from the Wakanda Forever soundtrack. Na the latest praise for the singer-songwriter who dem don list for one Golden Globe and Grammy awards some months ago.

 The 27-year-old Tems never come outside talk anything on top the matter, but fans of the star don dey jollificate with her for social media. The matter shock many pipo as dem no pick Viola Davis and ‘The Woman King’ wey she also dey inside for dis year Oscar.

 Voting for the 2023 Oscar go run from March 2nd go March 7th, before the award night eself wey suppose happen on Sunday the 12th of March for the Dolby Theater and na comedian and talk show entertainer Jimmy Kimmel go front the show.

More Posts