Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

President Tinubu don approve the take-off of Consumer Credit Scheme

April 25, 2024

President Bola Tinubu don approve di start of di first phase of di Consumer Credit Scheme (CCS), and e go start with members of di civil service.

According to one statement wey e media aide, Ajuri Ngelale, release today, dis initiative dey collaborate with financial institutions and cooperatives all over di kontri, and e dey important to di economy as e go help people access goods and services wen dem need am, and dem go fit pay small small over time.

Ngelale talk say di president believe say every hardworking Nigerian suppose get access to social mobility, and dis consumer credit go help dem buy important tins like house, motor, education, and healthcare wey go help dem achieve dia goals.

E also add say any working Nigerian wey wan benefit from dis consumer credit fit visit www.credicorp.ng to show interest before May 15.

More Posts