Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

NPFL don deduct 2 points from Enyimba International afta game disruption

May 2, 2024

Enyimba International don chop two points deduction from the Nigeria Premier Football League, NPFL, sake of say dem disrupt dia game against Doma United.


The points wey dem take deduct Enyimba na based on the decision wey the NFF disciplinary committee take to overturn the victory wey Enyimba bin get over Doma United.


The match wey happun on March 10, bin get wahala afta 88 minutes with the scoreline still 0-0. Enyimba later score one goal wey them bin admit initially, but the referee come consult with the Assistant Referee 1 wey raise im flag for offside.


The NFF don rule say the result of the match wen dem restart am afta dem cancel the goal wey dem say na offside, na (Nil-Nil).
Enyimba don drop to third position afta this judgement, but dem dey expected to appeal the ruling.

More Posts