Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Nigerian Education Loan Fund go publish schools wey get complete data of students by June 24.

June 14, 2024

Nigerian Education Loan Fund don talk say dem go publish full list of institutions wey don submit complete student data as dem request for upload onto NELFUND Student Verification System.

Head of Media, Nasir Ayitogo, talk for statement say dem go publish list of both Federal and State-owned institutions on June 24 to make everything transparent and to encourage proper access and participation for the scheme.

E add say for applicants to fit access the fund, dem details must dey inside the institution’s data wey dem submit to NELFUND Student Verification System, so dat automatic applicant verification fit happen without wahala.

 for more newshttps://naija102.com/lagos/ikorodu-city-nasarawa-united-elkanemi-warriors-and-beyond-limits-don-get-promoted-to-nigeria-premier-football-league/

More Posts