Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Nigerian Comedian Ali Baba and im wife don dedicate triplet sons for church ceremony

May 7, 2024

Nigerian comedian Atunyota Akpobome wey people sabi as Ali Baba and im wife Mary Akpobome don dedicate dia triplet baby boys for church.

The dedication happen for the RCCG Christ The Lord Central Parish for Lagos, and e be special moment for di Akpobome family.

After di solemn dedication service, dem hold reception for Jewel by Aeida for Hakeem Dickson Street for Lekki Phase 1, where family, friends, and well-wishers gather to celebrate di occasion.

Plenty celebrities from entertainment industry show face for di event, and e make am joyful well-well. Some of di celebrities wey attend include comedian AY Makun, Seyi Law, MC Lively, Chigul, Bunmi Davis, Ajebo comedian Adebola Williams, and plenty odas wey come to support and congratulate di Akpobome family.

More Posts