Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Nigeria don rank 30th for di latest FIFA men’s world ranking

April 5, 2024

Nigeria’s Super Eagles don drop two places for di latest FIFA ranking, but di three-time African champions still dey far ahead of their West African rivals Ghana.


For di February ranking, Super Eagles bin dey 28th for di world, but dem don drop reach 30th for di ranking wey dem release on April 4, 2024, afta di team get mixed results for last month international break.


Despite say dem drop two spots, Nigeria still dey third for di African continent behind Morocco wey dey 13th and Senegal wey dey 17th.


Egypt (37th), Cote d’Ivoire (38th), and Tunisia (41st) dey make up di rest of di top five for di African continent.


Meanwhile, world champions Argentina still remain di number one ranked nation, followed by France, Belgium, England, and Brazil.

More Posts