Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

CBN talk say dey no go extend deadline on old naira notes.

January 25, 2023

 The CBN don match leg for ground say dem no dey hear sam-sam and dem no go increase the January 31st deadline for the dropping of old naira notes.

 CBN Governor, Godwin Emefiele after yesterday Monetary Policy Committee meeting, e come repeat President Buhari bearing again say the 100-day window na enough time for we Nijans to go drop de old naira notes to exchange am for nkew ones, and the new notes dey available for banks to go pick up.

Emefiele con dey read the message from the Monetary Policy Committee meeting, e yarn us say the MPC don raise the standard interest rate by 100 basis points to 17.5%.

More Posts