Naija_logo
🎧 Listen Live πŸ”΄

Live on air

NASS talk say make CBN extend deadline on old naira notes

January 25, 2023

The Senate and the House of Representative don again talk say make dem increase the deadline wey the Central Bank of Nigeria set as the date wey the old N200,N500 and N1000 notes go expire.

Our tori-sabi person Raliat Adenekan and Nathan William report say the 2 law-making chambers of the National Assembly don dey ginger the President make him chook mouth and rule over the top bank to increase the deadline by 6 months.

 After one movement wey Senator Suleiman Sodiq of Kwara North move, e dey match leg for ground say the new notes no dey enough to move round, while e dey drag ear give say coming confusion go shele’ if dem no increase the deadline o. The Green chamber also talk say make the policy no dey too tight on top Nigerians if dem wan make e dey successful.

 Meanwhile, the House don set up one emergency committee to go meet with the Managing Directors of Business Banks and the CBN Governor, Godwin Emefiele over the halla pipo don dey give say the new notes no dey enough.

More Posts