Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Lagos Loves Damini Show Na Success – Show Organizers

January 3, 2023

The organizers of the show- “Lagos loves Damini”- wey carry Grammy Award winning singer Burna Boy, talk say the show turn out to be big success.

Pipo don dey lament for the Lagos show wey dem do for the Eko Energy Centre, after Music Fans don already wait over 8 hours for one 1-hour performance wey Burna boy do. The show suppose start by like 6pm but e no start till 10pm and Burna Boy no perform till 3am.

But the organizers, Wonder X, for the statement on Monday con apologize for the engineer mistake wey make dem start the show late, but talk say Burna Boy wey lead the 30-man band, carry the 30,000 Lagos crowd through one wide set wey con dey to-to-ri the crowd as dem dey jump with excitement. The Wonder X team also con dey thank the fans wey comot dea houses to show dea love for Burna Boy, even as dem dey wait all dat long wait dem still keep faith and at last dem see with dea okpolo eye the wonderful musical performance ever.

More Posts