Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

House of Reps don assure say 1.5 Billion Litres of petrol dey available, dem dey call for calm

May 2, 2024

The House of Representatives Committee on Petroleum Resources, Downstream and Midstream don yan say based on wetin dem find, petrol products dey available for country, but supply and distribution don dey disrupted by wahala wey concern transport vessels.

Our tori person, Nathan Williams, report say di downstream and midstream committees, wey Hon. Ikenga Imo Ugochinyere and Hon. Henry Okojie dey lead respectively, talk dis one today for di House of Representatives Press Centre.

Dem confirm say petrol products dey available, reach about 1.5 billion litres wey fit last for 30 days.

More Posts