Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Federal Government wan close Third Mainland Bridge for five weeks so dem fit repair am.

November 2, 2023

On Wednesday, the Federal Government, through the Ministry of Works, talk say dem go close two ramps for Third Mainland Bridge make dem fit do repair. For di statement wey Engr. (Mrs.) O. I. Kesha, wey be Federal Controller of Works for Lagos sign, e talk say make motoring public know say dem go start di repair for di ramps wey connect Oworoshoki to Adekunle and Lagos-Island (Adeniji Adele) to Adekunle at di same time.

Keisha talk say dem go close these ramps to traffic from 7 a.m. on Monday, 6th November 2023, and e go last for 5 weeks. She come advise motorists say make dem cooperate with traffic management officials, make dem dey follow di diversions wey dem give, and make dem use alternative routes wey dem don provide.

More Posts