Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

The Federal Executive Council has approved the mandatory Airport Gate Access payment for every single individual including Military personnel and Very Important Personalities (VIPs) at Airports across the country.

Federal Government don compel VIPs make dem pay access fees for airports

May 15, 2024

The Federal Executive Council don approve di compulsory Airport Gate Access payment for every single person including Military personnel and Very Important Personalities (VIPs) for Airports across di kontri.

Briefing state House Correspondents afta di 2-day long Federal Executive Council (FEC) meeting wey President Bola Ahmed Tinubu chair for Abuja, di Minister of Aviation, Festus Keyamo yan say di Council approve di compulsory Eticketing even for di President and Vice President Convoys, sake of to reduce di over 85 percent revenue losses wey suppose dey channelled towards airport infrastructure maintenance.

Our correspondent, Raliat Adenekan report say di Aviation Minister also reveal say di Council approve for di Ministry di purchase and installation of Recovery Systems equipments worth N4.2 Billion.

E also tok say e dey determined to make sure say strict regulatory supervisions dey for di aviation sector to prevent airlines or sector players wey dey coma from dey cause wahala for di industry.

For more news https://naija102.com/lagos/blog/

More Posts