Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Everton don spoil Liverpool title challenge with 2-nil victory for Merseyside derby

April 25, 2024

Everton don finally win dia first Merseyside derby for Goodison Park since 2010, as dem beat Liverpool 2-0 last night.

Di result don scatter Liverpool’s hope to win di Premier League title, as e still keep Jurgen Klopp’s men three points behind Arsenal wey dey top di table, and just one point ahead of Manchester City wey get two games wey dem never play.

Liverpool don win just one of dia last four league games, and dem don comot from FA Cup and Europa League recently.

Elsewhere, Manchester United bounce back from behind to knack Sheffield United 4-2 for Old Trafford. Jean-Philippe Mateta score twice as Crystal Palace beat Newcastle 2-0 to secure Premier League football for anoda season. And Antoine Semenyo score di only goal as Bournemouth wey dey 10-man beat Wolves for Molineux to move enter top half of Premier League table.

More Posts