Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Ekiti government talk say dem go soon reunite rescued pupils and teachers wit dem families

February 8, 2024

The Ekiti state goment don yan say dem go soon discharge di pupils and teachers of Apostolic Faith Nursery and Primary School wey dem rescue from kidnappers, plus dem teachers, wey dey receive treatment for Ekiti State University Teaching Hospital, Ado-Ekiti (EKSUTH).

Di students and dia teachers bin waka come di hospital from Emure Ekiti on Sunday for medical attention afta dem release dem from di kidnappers.

Di Ekiti State Commissioner for Health and Human Services, Oyebanji Filani, yan newsmen say dem dey for stable condition and e happy wit di progress dem don make for dia recovery.

Di Chief Medical Director, Prof. Olabanji Kayode talk say di rescued pupils don improve but dem still dey work on dia psychological state of mind sake of di trauma wey dem go through from di kidnappers.

More Posts