Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

EFCC don release 58 OAU students wey dem arrest for suspected internet fraud.

November 2, 2023

EFCC don release 58 out of 69 students from Obafemi Awolowo University wey dem arrest before for suspected internet fraud. EFCC spokesman, Dele Oyewale, don confirm di release and talk say “many of the suspects wey dem don profile for the Command don dey released, and dem go complete profiling for those wey never release without delay.”

Earlier for the day, the anti-graft agency bin arrest these students for a midnight raid for hostels outside the campus. According to EFCC, dem arrest dem based on actionable intelligence say dem dey involved for internet-related fraud activities.

More Posts