Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Dangote Refinery don further reduce prices of diesel and aviation fuel

April 24, 2024

Dangote Petroleum Refinery don yan say dem don reduce di prices of diesel and aviation fuel further to N940 and N980 per litre, respectively.

Di Head of Communication, Anthony Chiejina, talk say di price change to N940 na for customers wey dey buy five million litres and above from di refinery, while di price of N980 na for customers wey dey buy one million litres and above.

E reveal say di refinery don arrange one strategic partnership with MRS Oil and Gas stations, to make sure say consumers fit buy fuel at affordable prices, but dem go extend di partnership to other major oil marketers.

Di price reduction dey come afta dem reduce di price to N1,000, from N1,200, just two weeks ago, and pipo don dey hail am.

More Posts