Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Burna Boy don set new African record for highest-grossing venue for US

May 2, 2024

Nigerian music powerhouse Burna Boy still dey make history as e dey push di boundaries of global commercial success for African music. For anoda major achievement, Burna Boy don become di African artist with di highest grossing venue for di United States.

According to Touring Data on X, Burna Boy concert for 2024 wey happun for TD Garden Arena for Boston, don gross $1.593 million, wey pass di previous African record wey e set for Madison Square Garden for 2022.

For dis historic concert, Burna Boy sell out di 19,000-capacity TD Arena Garden for Boston as part of im ‘I Told Them’ Tour, wey don already gross $11,659,531 from 11 reported shows of di 22 stops.

More Posts