Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Borussia Dortmund don defeat PSG to reach Champions League final

May 8, 2024

Borussia Dortmund don qualify for di Champions League final afta dem win 1-0 against Paris Saint-Germain for Parc des Princes on Tuesday, wey give di Germans 2-0 win on aggregate.

Matt Hummels na di hero for di night as him 50th-minute header secure di final spot.

Dortmund go face either fellow German side Bayern Munich or 14-time champions Real Madrid for di final for Wembley on June 1.

Dortmund, wey dey fifth for di German Bundesliga, nobody expect say dem go reach dis level and dem go be underdogs for di June 1 final whether dem face dia old rivals Bayern Munich or Real Madrid, wey go play on Wednesday.

More Posts