Naija_logo
🎧 Listen Live 🔴

Live on air

Bobrisky don file appeal wey dey challenge im conviction for Naira abuse

April 23, 2024

Bobrisky don carry matta go court, don file notice of appeal wey dey challenge im conviction on top four-count charge of Naira abuse.

For di notice of appeal wey im lawyer, Bimbo Kusanu file, Bobrisky dey beg court make dem throway di six months imprisonment wey dem give am and instead make dem give am option to pay fine of N50,000 (Fifty Thousand Naira) for each of di charges wey dem accuse am of.

Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Lagos bin sentence Bobrisky to six months inside prison without option for fine sake of say im abuse Naira. Im tok say di judgement go make people wey dey do di same thing think twice.

Bobrisky, for im Notice of Appeal, tok say di trial court bin give am di highest punishment even though im no get any previous record of conviction, and dem get options to give am lesser punishment.

More Posts