Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Tunisia President don increase State of Emergency

February 2, 2023

Tunisian President Kais Saied don drop one decree wey go increase the state of emergency wey don dey ground for the country since 2015. According to the state news agency we dem call TAP, dem increase the state of emergency until the end of December dis year.

 Mr. Saied increase state of emergency last time for one month on the 30th of December. The early announcement dem bin make before one state of emergency na for November 2015, after one bombing wey bin target one bus wey dey carry presidential guard forces, wey con kill 12 of the guards.

Two major attacks rock the country for early dat year on top visitors for the capital Tunis and the holiday town of Sousse.