Live on air

🎧 Listen Live 🔴

 Nine Players Don Enter Super Eagles Camp Before AFCON Qualifiers

March 21, 2023

 Nine players don dey the Camp of the Super Eagles as the team don dey ready for the 2023 AFCON finalist against Guinea-Bissau. Goalkeepers Francis Uzoho, Chijoke Aniagboso and Wilfred Ndidi be the latest players wey enter the Super Eagles Abuja camp before the match.

The six oda players wey enter the camp on Monday na Semi Ajayi, Alex Iwobi, Kelechi Iheanacho and Kelvin Akpoguma and dem join the team for dea first training time yesterday.

Meanwhile, the Djurtus of Guinea-Bissau go enter Abuja on Wednesday for the 2023 Africa Cup of Nations qualifying match day four experience against the Super Eagles of Nija.

Baciro Cande men go fly straight go the Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja from the Osvaldo Vieira International Airport, Bissau.