Live on air

🎧 Listen Live 🔴

MultiChoice don ready for the ninth copy of the Africa Magic Viewers Choice Award (AMVCA).

February 21, 2023

 MultiChoice don carry microphone tell us say dem wan start to ready for the ninth copy of the Africa Magic Viewers Choice Award (AMVCA).

Na dea head of Content and West Africa Channels, Dr Busola Tejumola, carry mic yarn dis update for one statement yesterday, she con dey call on all African filmmakers make dem drop dea movies and films wey dem don show or broadcast give the world between December 1, 2021 go January 31, 2023, for 2023 copy of the awards.

According to her, the portal to enter go open on the 20th of February and close on the 10th of March, 2023. To take enter the awards, all filmmakers gats prepare one 5-minute-long video, the video gats dey less dan 300MB and after drop am for the Africa Magic website, the website go con give special reference number to each person wey don submit dea own online.

 According to Tejumola, the ninth copy, wey suppose happen later for the year, go see dem bring back the ‘Best Online Social Content Creator’ group wey comedian ‘Sabinus’ carry go house last year.