Live on air

🎧 Listen Live 🔴

More than 2,500 pipo don die for Turkey and Syria after major earthquake

February 7, 2023

Rescuers dey battle heavy rain and snow as dem dey race against the clock ‘tick tock’ to find pipo wey survive the deadly earthquake for south-east Turkey.

The World Health Organization don drag ear give say the numbers fit increase by eight times as rescuers dey find more pipo wey the earthquake don kpalaka, as South Korea be the latest country wey put hand outside say dem wan epp Turkey. On Tuesday morning, President Yoon Suk-yeol drop one order make dem send rescuers and emergency medical items go the country.

The head of the country disaster and emergency agency, Yunus Sezer, yarn us say the number of pipo wey dem don confam say dem don peme for Turkey don rise go 2,921, e con add say another 15,834 pipo don carry wound for body.