Live on air

🎧 Listen Live πŸ”΄

Kenya Spread Malaria Injection For Small Pikins

March 7, 2023

Share on facebook
Share on whatsapp
Share on twitter
Share on telegram
Share on linkedin

 Dem wan inject plenty-plenty children under the age of five for western Kenya, as the ministry of health don roll out dea Malaria Programme to FIVE COUNTRIES there.

 Dem first start the β€œRTS,S” injection for 2019 inside EIGHT COUNTRIES wey get high malaria load, as dem bin wan try epp bring down the number of children wey dey enter hospital because of malaria or dey peme because of am. The World Health Organization tok say dem go roll out the injection round all of sub-Saharan Africa, but the pipo wey dey produce the injection, GlaxoSmithKline, tok say only 15 million amount of the injection dem go fit dey produce every year.

Malaria, the sickness wey na mosquito bite dey cause am don kpie more dan 400,000 pipo every year, most of dem na children for sub-Saharan Africa.