Live on air

🎧 Listen Live πŸ”΄

Ghana Military deny hand for the killing of the civilians for Bawku town

February 3, 2023

Ghana military don deny the tok of say dea officers chook hand for the killing of nothing less dan 10 civilians for Bawku town, for the north of the country, wey dey close to the border with Burkina Faso.

Dem kpie the civilians for different accidents and Mahama Ayariga, (MP for Bawku Central), blast the accidents. Pipo wey dey dere when the matter happen claim say dem see men wey gage with military uniform con dey chase and fire bullet for civilians on Wednesday.

Dem add say for the Missiga area of Bawku alone, dem kpie eight pipo including one 12-year-old boy who dem burn reach ground for one grain storehouse, where e run go pete’ during the attack.

The military high command don drop one statement before wey dem dey drag ear give pipo make dem stop to dey wear military uniforms; as dem dey show us say dem don handcuff one person unto say e go dey re-spray one motor with military color for Bawku, about one month ago.