Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Flying Eagles Don Ready for Uganda Challenge for Africa U20 Cup of Nations Quarter-Final Match.

March 2, 2023

 The Flying Eagles of Nigeria don win the Total CAF U-20 group stage Fair Play award. Dem carry microphone yarn us dis one for the CAF U-20 Twitter handle wey Twitter don confam.

 Meanwhile, the Flying Eagles don continue to ready for dea quarter-final battle against Uganda today Thursday for the Africa U20 Cup of Nations wey dey happen now. Head coach Isah Ladan Bosso tok say e trust say him men go win the match and dem go reach the FIFA U20 World Cup finals wey go happen for Indonesia, from 20th of May go 11th of June.

The coach tok say wetin the team dey try aim for na to kolobi the World Cup ticket, but dem also still dey eye the trophy. Nigeria go play Uganda for the 22,000-capacity Suez Canal Authority Stadium for Ismailia wey go start 6pm Nija time on Thursday.