Live on air

🎧 Listen Live 🔴

FG deny say dem sabi any person wey dey work against Bola Ahmed Tinubu

February 2, 2023

The Information Minister also don answer to the statement wey Governor Nasir El-Rufai of Kaduna State drop say some “elements” for the Presidential Villa dey work against the presidential flagbearer of the All-Progressive Congress (APC).

E repeat the President position say him administration only dey chook eye for how dem go make sure say one free, fair election wey person go fit believe go happen and e no dey favour any person or cause any person to enter trouble, e add say if any person dey work against any candidate, dem never officially know the person or confam the tori.

The Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai , don drop claim before say some “elements” for Aso Rock dey put all dea forces so Tinubu no go come out as President, e talk the “naira redesign policy” as one of many plans wey dem dey target give the APC presidential flagbearer.

El-Rufai, wey speak for one talk-talk, explain say the pipo wey dem point finger give dey vex say Tinubu flog dea own person for the June 2022 APC presidential primary.