Live on air

🎧 Listen Live 🔴

13 Political Parties don tell CBN say no General Election, if dey increase the Naira Exchange Deadline

February 7, 2023

Thirteen political parties out of the 18 political parties for Naija don put fear for the mind of CBN and Federal Government say dem go use soap and water wash hand comot from the 2023 general election wey suppose happen on the 25th of February and 11th of March, if the CBN increase the deadline of February 10th, for the naira exchange.

The National Chairman of the Action Alliance, Kenneth Udeze con dey speak on behalf of the parties yesterday for Abuja, e tok say the parties dey clap hand give the Presido and the CBN Governor, Godwin Emefiele on top the redesigning of the naira notes, dem con dey match leg for ground say the policy gats stand.

The parties also point finger give Kaduna, Kogi and Zamfara state government say na dem dey run go the Supreme Court to collect court order wey go increase the deadline of the three old naira notes so dem fit still dey legal.