Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Dem Don Pick Tobi Amusan For 2023 Laureus World Sports Awards

February 21, 2023

 Dem don pick Nigeria 100 meters race star, Tobi Amusan, for the 2023 Laureus World Sports Awards.

The Laureus Awards na one every year award ceremony wey dem dey use take value each persons and teams from the world of sports along with different things pipo don gain for the sporting world throughout the year. Dem pick Amusan for the World Breakthrough of the Year group along with five oda pipo wey dey drag for the same group.

 The oda pipo dem pick for the group be Tennis stars Carlos Alcaraz and Elena Rybakina, dem enter semi-finals for the Qatar 2022 World Cup Atlas Lions of Morocco, American skater Nathan Chen and American professional golfer Scott Scheffler.