Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Atiku Abubakar Lead PDP Protest March Go INEC Headquarters, On Top Presidential Election.

March 7, 2023

 The Presidential flagbearer of the People Democratic Party (PDP) Alhaji Atiku Abubakar, the vice presidential flagbearer Dr. Ifeanyi Okowa  and oda PDP leaders bin lead one PROTEST MARCH yesterday go the Independent National Electoral Commission (INEC) Headquarters, Abuja to take show how INEC don fall dea hands as dem no transfer the Presidential results on top the IREV stand.

Spokesperson Atiku/Okowa Campaign Council Daniel Bwala, for one tok-tok yarn us say the leadership of PDP between oda things dem want dey ask the INEC make dem “cancel the elections” as dem put leg for ground say INEC dem “arrange” the process. The former PDP spokesperson, Kola Ologbondiya for him comment yarn us say the party frustration dey chook hand with the promise wey INEC oga no gree keep.

Meanwhile, INEC don match leg for ground say dem no get loyalty to any party just as the president wey dem pick Asiwaju Bola Tinubu, con dey direct Atiku make him respect him age, as e maintain say the PDP protest go INEC headquarters na foolishness, and say make e go court where dem go hear all him problems and no be for the INEC headquarters.

Tinubu don disagree with Atiku on top the performance and result of the election, as e say the PDP flagbearer no fit smell the winning line of the election and make e stop all the go-slo e dey cause for Abuja through the protest.