Live on air

🎧 Listen Live 🔴

Argentina, Chile, Paraguay, Uruguay Drop Join-Body Offer For 2030 FIFA World Cup

February 9, 2023

Argentina, Chile, Paraguay and Uruguay don officially drop dea join- body offer to organize the 2030 World Cup, 100 years after the first match wey dem do for Montevideo.

The four South American countries don dey shout make the World Cup go back to “where dem bin born football”, and dem dey try shake of anoda join-body offer competition from Spain and Portugal, and future offers from Morocco and Saudi Arabia.

The United States, Canada and Mexico don already dey join hands together to organize the 2026 World Cup.